Home › Touch Of Thoughts       22.2.2009

GIRL O GIRL

Girl o girl

See how she dey waka

Like she dey Akata

She no dey ever beg

Posing with one leg

Carry bag for hand

No send her errand

Skirt wey short

Blouse wey hot

Mama say na waya

Papa say him taya

Na dis one be vogue

As grandma come

E begin to hala

Dis na wahala

Pikin dis days

Know nothing but plays.


By Chovwe Ogbe