EGO!
Ego,
Na becos of you I go school
Make I for learn
Make I know things
Make I take get work
So that my life go better
Ego,
Na because of you I go market
I come build house
I come buy motor
I come chop well
You sweet no be small
Ego,
Na because of you I dey popular
My friends dem borku
My enemies yanfuyanfu
My elders sef respect me
Babes no dey finish
Ego,
Na you bring my palaver
No sleep again
No rest of mind
No where to hi de
E don get as e be
Ego,
Na many names you get
Oyibo call it money
Hausa call him kudi
Yoruba call her owo
As I see am so poverty no be curse.
By Chovwe Ogbe for http://nollywoodgists.com
Latest News
-
DJ Timmy Calls Out Timi Dakolo Over Alleged Debt, -
Alex Unusual Says Emotional Suppression Is Not Pro -
Yvonne Jegede Says Nigerians Make It Hard For Cele -
Your Birthdays Excite Me More Than They Do You – I -
Jide Awobona Slams Colleagues Who Troll, Shade Fel -
RMD Joins Male Feminists Network, Advocates For Wo -
Bisola Aiyeola Shares Painful Lesson On Inheriting -
Don't Rush Into Marriage Without Money – Jarvis -
My Daughters Asked Why They Have Different Moms – -
Peller Vows To Cut Off Celebrities Who Skip His Wh

