Commics News | 21 September 2012 05:44 CET

MR-KNOW ALL(A Yabis Column)

By Agency reporter

DEAR MR KNOW ALL

I hear say Governor Rochas Okorocha don sack some Chairmen for Imo State, talk say their tenor don finish. Wetin you want talk for the matter.

Iyke Abia State.

DEAR IYKE

Watin. This one no mean anything, if their tenor finish den suppose come down. Watin again u want make I talk. E bi like say you follow dem dey chop our money.

DEAR MR KNOW ALL

Dis one way dem dey talk say President Goodluck Jonathan wife dey abroad for medical treatment. Na true?

stanly, P.H. City

DEAR STANLY

Den tell you say na me be Patient Jonathan Personal Assistance? I hear say de woman dey one play for abroad dey enjoy their money, una dey here dey carry fake news. U no go find how you go take get money.

DEAR MR KNOW ALL

Ini Edo bi bloody liar. Why she dey deny de belle way she carry before. Abi she dey shame say e carry belle?

Angel, Enugu.

DEAR ANGEL,

No mind dem. Na so dey take dey deceive dem self dey think say dem dey deceive people later dem go talk say na media dey carry fake stories. You fit insult de British or American media and go away with it dat way. Dem go finish your career.

DEAR MR KNOW ALL

Why some Nigerian Artistes dey collect money for shows dey no go come show up again? Dat thing no bi fraud?

Abuchi, Abuja.

DEAR BUCHI,

Na fraud abi. No mind dem na so dem dey spoil our name for abroad. Na greediness dey kill naija people especially our celebrities. One day dey go do de one way dem go take go jail.

Click the link below to go to...

Photos: Charly Boy's Female Gay Personality 'Linda' Revealed

Indian Doctors` Shocker! 1st Lady Dying of Tapeworm Infection

Pictures From Pregnant Ini Edo, Hubby, AM Victorious' Fashion Collection Launch In Dallas

Lesbianism Tale: Rukky Sanda Angry With Journalists? Allegedly Curses Journalist Over News Story

Peter of P-Square On Mission To 'Kill' Female Fans With Sexy 6 Packs' Body?

Genevieve, Rita Dominic, Segun Arinze Storm 2Face's Birthday Bash At Rumours Club [Pictures]

Dear President Goodluck Jonathan, You Need A Reality Check

Goldie On Tour, Visit Prezzo In Kenya

Davido Debunks Bitter Fight With Wizkid, Says

Funny Memories Of The Past

Celebrity Birthday: Mike Ezuruonye Adds Another Year

Other sites The Nigerian Voice